Academic Staff Union of Universities – (ASUU)

COVID-19 Updates

ADDRESS:Comrade Festus lyayi Complex, University of Abuja, Giri Campus, Airport Road, Giri, F.C.T Abuja

ASUU strike update today: Academic Staff Union of Universities go hold a meeting to decide next step

Di Academic Staff Union of Universities say dem go soon hold meeting to decide if dem go-go on strike.

Di National President of di union Victor Osodeke tell BBC Pidgin say “ASUU go meet soon and decide dia next steps.” and im dey Abuja with im colleagues for di meeting.

Im words dey come as some reports say di union bin dey ginger to embark on anoda strike afta wetin dem call di failure of the Federal Government to implement one agreement dem sign with di union.

But di ASUU leader don say dem never decide anything about strike now until dem hold dia own meeting.

Although e add say, dem get agreement with FG to sort out some issues before August 31st and one day to dat date and di federal goment no longer dey tok to dem.

“ASUU no like to dey go on strike, but we dey fight for di good of di Nigerian students”

“Goment promise us moni to use buy equipment, as I dey tok to you some schools no get equipment, na for ground dem dey sit down … I come Abuja so dat we go decide our next steps”, e tok.

Some of di tins wey ASUU dey ask goment to give dem include Autonomy for Nigerian Universities, Independent payment System and payment of backlog of salaries wey goment dey owe dia members.

Oga Osodeke add say di Integrated Payroll and Personnel Information System (IPPIS) payment platform no good for lecturers.

“How you go tell all your lecturers to submit all dia data to foreign bodi, e no good na, wen foreigners dey come lecture hia ma contract we dey give dem.

“Now goment want make we hand over all our details to foreign bodi, di system no even dey accurate becos some time dem dey cut salaries adn oda times dem dey over pay some pipo, how we want take trust dat kain system.” Im add.

File foto of FG with representatives from ASUU
Wetin we call dis foto,File foto of FG with representatives from ASUU

Wetin be di issues?

Di union bin go strike for March 2020 to put pressure on goment to meet dia 2009 agreement.

Di major issues bin centre around universities dia revitalization moni, earned allowance, Integrated Payroll and Personnel Information System (IPPIS) payment platform and payment of witheld salaries.

For the meeting wey lead to dem calling off di strike for 24, December, 2020, goment bin negotiate to pay dem 40 billion Naira earned allowance and 30 billion Naira revitalisation moni.

Goment also agree to do integrity test for dia own payment system wey dem want wey be UTAS.

For anoda meeting dem hold for March 2021, representatives of di goment and di lecturers bin agree to dey do regular review of di progress wey dem don make as e take concern how dem implement di Memorandum of Agreement (MoU) wey two of dem sign.

Di meeting bin follow complain of ASUU members earlier on say di Accountant General of di Federation [OAGF] dey frustrate di payment of salaries goment agree to pay di lecturers afta dem dem bin suspend dia nine months old strike.

Chris Ngige, di Minister of Labour and Employment bin tok afta dat meeting with ASUU leadership for Abuja say, dem also gree to meet again before end of May 2021 make dem take review di agreement.

“We bin get some protests and we manage am. Today, we don gree to find way accommodate di balance so dat we fit pay as when due.

We also torch-light all di salaries wey bin no dey captured by di office of di Accountant General of di Federation [OAGF], wey make some lecturers no get dia amount of payment since December or January 2020.” Ngige bin tok.

3 thoughts on “ASUU strike update today: Academic Staff Union of Universities go hold a meeting to decide next step”

Leave a Comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *